Library · pcm

Psalms 24

24:1 Na God get di eart and evritin wey dey inside. Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too. 24:2 E build di eart foundashon on-top sea kon make am stand on-top wota. 24:3 Na who go fit klimb go God mountin? Na who go fit stand for en Holy Place? 24:4 Na only doz wey get klean hand and pure heart; pipol wey nor dey serve juju or lie or do bad tins. 24:5 Dem go get God blessing kon bi di God wey dey save dem, friend. 24:6 Dis kind pipol dey go find and woship am, bikos na-im bi di Oga wey bi Jakob God. 24:7 Naw, evry old gate, make una open! Evry old door, make una open, so dat di King wey get glory go enter inside. 24:8 Who bi dis King wey get glory? Na God wey dey strong and get pawa well-well; God wey get pawa to fight war. 24:9 Naw, evry old gate, make una open! Evry old door, make una open, so dat di King wey get glory go enter inside. 24:10 Who bi dis King wey get glory? Na di Oga God of all ogas; Na-im bi di King wey get glory.