Library · pcm

Psalms 26

26:1 My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent. 26:2 O my God, make Yu look mi well-well, den test my heart, so dat Yu go know wetin I dey tink. 26:3 Bikos I dey sure about yor love wey nor dey fail and I dey live my life, just as Yu sey make I leave am. 26:4 I nor get time to spend with lie-lie pipol or waka with dem. 26:5 I hate to dey where bad pipol dey and I nor go ever follow wiked pipol waka. 26:6 My God, I dey live my life well, so dat I go fit kom yor altar 26:7 kom tank and tell Yu about all di wonderful tins wey Yu don do. 26:8 Oga God, I love yor temple; di place where Yu dey and where yor glory for dey shine. 26:9 Make Yu nor let mi sofa with my enemies and nor kill mi with wiked pipol. 26:10 Dia hands dirty with di wiked tins wey dem don do and dem dey always take bribe. 26:11 But I nor bi like dat; I dey live betta life. So, make Yu kom save and sorry for mi. 26:12 Naw, I dey save and I don join di pipol wey dey woship Yu, so I go praiz my God.