Psalms 25
25:1 My God, na only Yu I dey depend on.
25:2 Na only Yu I trust, so make Yu nor let pipol disgrace mi or allow my enemies happy wen I fall.
25:3 Nobody wey trust Yu dey si disgrace, but disgrace na for doz wey dey try to deceive odas.
25:4 My God, make Yu show mi di rite way kon point di road wey I go follow.
25:5 Make Yu tish mi, so dat I go know di trut, bikos na Yu bi di God wey save mi and evriday, I dey put my hope for yor hand.
25:6 My God, remember yor kindness and love wey nor dey fail, wey Yu dey show us, since awa grand-grand papa time.
25:7 Make Yu nor remember di sins wey I kommit wen I yong. Remember mi for di lite wey yor love wey nor dey fail dey bring, bikos Yu my God, dey sorry for pesin.
25:8 God dey good and E dey do wetin dey rite; E dey show di rite road to pipol wey dey waka lost.
25:9 Doz wey dey honbol, E dey help dem do wetin dey rite, bikos E dey tish dem en ways.
25:10 All doz wey dey keep God kommand and obey en laws, E dey show dem en faithfulnes kon lead dem with love wey nor dey fail.
25:11 My God, bikos of di honor wey yor name get, make Yu forgive mi my many-many sins.
25:12 How wi go take know doz wey dey fear God? Na doz wey God go show di rite road wey dem go follow.
25:13 Dem go prosper and dia shidren go inherit di land.
25:14 God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant.
25:15 Na God I always dey look up to, bikos na-im save mi from di trap wey my enemies set.
25:16 Make Yu turn kon sorry for mi, bikos na only mi dey and I dey sofa well-well.
25:17 My problems dey worse evriday. So, make Yu save mi from wahala!
25:18 Make Yu feel my pains kon si my trobol, den Yu go forgive mi all my sins.
25:19 Si as my enemies many pass mi and as dem hate mi rish!
25:20 Make Yu protet mi! Make Yu save my life from dem! Nor let mi si shame, bikos na only Yu go fit save mi.
25:21 As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.
25:22 So my God, make Yu save Israel pipol from all dia trobols.