Psalms 32
32:1 Di pesin wey God forgive en wiked ways and sins, make e happy!
32:2 Yes, make doz wey God don forgive dia sins happy well-well; doz wey dey live betta life naw!
32:3 Wen I nor gri konfess my sins, my body kon dey die go and I kon dey kry with pain.
32:4 Both day and nite, God just dey ponish mi. My strent die go like wota wey dry, bikos of heat.
32:5 So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do. I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.” And E really forgive mi!
32:6 So make evribody wey dey fear God pray to am as time still dey, so dat dem nor go sofa for judgement day.
32:7 Na God bi di place where I dey hide put and E dey protet mi from trobol. God surround mi with song and happiness from doz wey E diliver.
32:8 God sey, “I go guide and take yu pass di best road for life. I go advise and wosh ova yu.
32:9 So, make yu nor bi like horse or animal wey nor get sense and wey nid kane to kontrol am.”
32:10 Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.
32:11 So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!