Library · pcm

Psalms 33

33:1 Una wey dey fear God, make una sing with joy; bikos e dey good make pipol wey get pure heart, praiz am. 33:2 Make una praiz God with di sweet sound from jita; make una use harp take sing to am. 33:3 Make una sing new song take praiz am; make una play di harp make e loud well-well. 33:4 Bikos God word na true and wi fit trust evritin wey E dey do. 33:5 E love anytin wey dey rite and good; God love wey nor dey fail, full di eart. 33:6 Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear. 33:7 E gada di sea for one place kon keep di ocean for where e dey. 33:8 So, make di whole world fear God and make evribody kom bless en name. 33:9 Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons. 33:10 God skata di nashons plan kon spoil wetin dem won do. 33:11 But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all. 33:12 Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own. 33:13 God dey look from heaven. E dey from der look all di pipol wey E kreate. 33:14 Evritin wey dey alive for dis eart, God dey look dem from en throne. 33:15 Na-im make dia heart, so E undastand evritin wey dem dey do or tink. 33:16 Just as di plenty sojas wey king get nor go fit save am, na so too pesin pawa nor go fit save am. 33:17 So make yu nor feel sey na yor shariot go make yu win, bikos with all en strent, e nor go fit save yu. 33:18 But God dey guide doz wey dey fear am; doz wey bilive en love wey nor dey fail. 33:19 E save dem from deat and keep dem alive wen honga dey. 33:20 Na God bi awa hope. Na-im dey help and guide us. 33:21 Awa heart dey always happy, bikos of am and wi trust en name wey dey holy. 33:22 My God, make yor love wey nor dey fail, protet us, bikos na Yu bi di hope wey wi get.