Psalms 34
34:1 I go always dey praiz God. I go always dey tok about all di good tins wey E dey do.
34:2 Na only God name I go take boast; so make doz wey dem dey opress, listin and happy well-well.
34:3 Kom make wi tok about how God great rish; kom make wi praiz en name togeda.
34:4 I pray to God and E ansa mi kon free mi from all my fear.
34:5 Doz wey dey go meet am make E help dem, go happy well-well and shame nor go ever katch dem.
34:6 I pray to God as I dey sofa and E ansa mi; E save mi from evritin wey dey worry mi.
34:7 Bikos na God angel dey guide mi, na so too E dey protet and guide all di pipol wey dey fear am.
34:8 Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good: Make yu si as God bless di pipol wey bilive am!
34:9 Una wey bi God pipol, make una fear am, bikos doz wey dey fear am go get evritin wey dem nid.
34:10 Yong lions wey strong well-well still dey hongry, but doz wey trust God go get all di good tins wey dey dis world.
34:11 My shidren, make una kom listin to mi and I go tish una how to fear God.
34:12 E get anybody wey won live betta life? Anybody like to get long life?
34:13 Den make yu nor use yor mout take tok bad tin and make yor lips nor dey lie!
34:14 Make yu turn from wiked tins kon do wetin dey good. Make yu dey leave for peace with evribody and do evritin to keep am like dat.
34:15 Pipol wey dey do wetin dey rite, God eye nor dey komot from dia body and en ear dey open to hear wen dem kry for help.
34:16 But God dey trowey en face from doz wey dey do bad tins; E dey remove dem from dis eart.
34:17 God dey hear en pipol wen dem koll am for help. E dey save dem from all dia wahala.
34:18 Pipol wey nor get hope, God dey-dey near dem; E dey save doz wey dia spirit dey die.
34:19 Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well, but God go save dem from all dia wahala.
34:20 God dey protet en pipol well-well and E nor go let any bad tin happen to dem,
34:21 but wiked pipol go must face wahala and God go ponish doz wey hate en pipol.
34:22 God go save pipol wey dey serve am and E nor go kondemn anybody wey dey obey am.