Library · pcm

Psalms 40

40:1 I wait with patient make God kon help mi, and E turn kon hear my kry. 40:2 E take mi komot from di pit where shame, pain and sofa full kon put my leg for groun wey strong well-well, den E make mi strong as I dey waka. 40:3 E don give mi new song to sing and hymns wey I go take praiz awa Oga God. Many pipol go si wetin E do kon praiz am, den dem go start to trust God. 40:4 Make una si as pipol wey trust God dey happy; doz wey nor like proud pipol or woship juju. 40:5 My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish. 40:6 Yu really don make mi undastand sey, nor bi only sakrifice and ofrin yu wont. True-true, Yu nor just wont only burnt or sin ofrin. 40:7 Den I sey, “Look, I don kom, just as dem rite about mi for yor Book sey: 40:8 ‘My God, I won do wetin Yu wont, bikos Yu rite yor laws for my heart.’ ” 40:9 I don tell yor pipol about how Yu dey judge. I nor dey fear to tok about all di good tins wey Yu don do. 40:10 All di good tins wey Yu do, I nor keep dem for my heart; but I don tok about as Yu dey faithful and yor pawa wey dey save pipol. 40:11 So Oga God, make Yu nor stop to dey sorry for mi. Make yor love and faith wey nor dey fail, always dey protet mi. 40:12 Trobol gada round mi and I nor fit kount dem! My sins don many well-well and I nor sure sey I go fit dey free from dem! Dem many pass di hair wey dey my head and I don lost all my hope. 40:13 So my God, abeg, make Yu save mi! Make Yu kwik-kwik kom help mi. 40:14 Make shame and disgrace follow di pipol wey dey try to distroy mi. Pipol wey dey happy bikos I dey sofa, make disgrace follow dem. 40:15 Make shame and disgrace follow dem, bikos dem sey, “Yes o-o! Wi don get am naw!” 40:16 But pipol wey dey find Yu, make joy and gladness full dia heart. Make doz wey love yor salvashon always dey shaut sey, “God dey great!” 40:17 I dey poor and I nor get anytin, so make God keep mi for en mind. My God, make Yu kwik kom, bikos na Yu bi my help and di Pesin wey go save mi.