Psalms 42
42:1 My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.
42:2 I dey hongry to know God! Di God wey dey alive. So na wen I go take stand for en front?
42:3 I dey kry both day and nite and na tears bi di only food wey I dey chop and my enemies dey tell mi sey, “Where dat yor God dey sef?”
42:4 I start to kry wen I remember as tins bi before! Den I dey waka with doz wey dey woship God; dey lead many pipol go God house and wi dey happy as wi dey sing and dey tank am as wi dey celebrate!
42:5 But wetin make mi nor get mind? Wetin make my heart nor happy at-all? I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and my God!
42:6 Naw, I nor get hope at-all, but I go remember Yu, even from Mount Hermon wey far and for Mount Mizar land wey dey Jordan River.
42:7 I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef! Yor wave and breeze dey make my heart shake.
42:8 But evriday, God dey pour en love wey nor dey fail for my life and evry nite, I dey sing en song, dey pray to God wey give mi life.
42:9 I dey kry dey sey, “My God wey bi my rock, wetin make Yu forget mi? Wetin go make mi dey waka with pains bikos my enemies dey opress mi?”
42:10 Dia wahala don break my bones. Dem dey laf dey sey, “Where dat yor God dey sef?”
42:11 Wetin make mi nor get hope? Wetin make my heart nor dey happy at-all? But I go still put my hope for God hand! I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!