Library · pcm

Psalms 44

44:1 My God, wi don hear am with awa own ear and awa grand-grand papa dem don tell us about evritin wey Yu do for dia time. 44:2 Yu use yor pawa take porshu doz wey nor dey fear Yu kon give all di land to awa grand-grand papa dem. Yu skata dia enemies kon free awa grand-grand papa. 44:3 Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem. 44:4 Na Yu bi my King and God. Na Yu make Israel pipol win. 44:5 Na yor pawa wi go take porshu awa enemies; na yor name wi dey take mash dem for groun. 44:6 I nor trust my bow, I nor put hope sey my swod go save mi, 44:7 but na Yu make us fit win awa enemies kon disgrace doz wey hate us. 44:8 My God, wi go always dey give Yu glory and praiz yor name forever and ever. 44:9 But naw, Yu don rijet and disgrace us. Yu nor dey follow awa sojas go fight again. 44:10 Yu make us run from awa enemies kon allow pipol wey hate us, pak awa propaty. 44:11 Yu don busher us give dem like animal wey dem won chop kon skata us among di nashons. 44:12 Na one-one kobo Yu sell yor special pipol and Yu nor gain anytin from inside. 44:13 Yu don let awa neighbours dey laf us. Pipol wey dey around dey take us make yeye. 44:14 Yu don make us di topik for dia joke; dem dey shake dia head for us like sey wi bi fools. 44:15 Na sofa and curse bi my own evriday; dem don rite shame put for my fore head. 44:16 Doz wey dey laf mi, na only dia vois I dey always hear and na only my enemies wey dey ponish mi, I dey si. 44:17 Even doh all dis tins dey happen to us, wi neva forget Yu. Wi neva go against yor kovenant. 44:18 Na only Yu dey awa heart and wi still dey follow yor ways. 44:19 Yu don skata us for groun like dirty wey dog dey run pass; Yu don kover us with darkness. 44:20 If wi don rijet awa Oga God kon dey pray to anoda god, 44:21 E go know, bikos E know wetin dey evribody mind. 44:22 Yet bikos of am, dem dey kill us evriday; dey trit us like sheep wey dem won kill. 44:23 So, my God, make Yu wake-up! Wetin make Yu dey sleep? Make Yu get up! Make Yu nor rijet us forever. 44:24 Why Yu dey look di oda side? Wetin make Yu do like sey Yu nor know sey wi dey sofa and wiked pipol dey opress us? 44:25 Wi don faint for groun kon sleep for dirty. 44:26 So my God, make Yu kom help us! Save us bikos of yor love wey nor dey fail.