Psalms 45
45:1 Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.
45:2 Na yu fine pass among evry oda man! Betta word dey kom out from yor mout and bikos of dis, God ensef don bless yu forever.
45:3 My strong warrior! Make yu karry yor swod kon appear with yor glory and majesty!
45:4 Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good. Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand.
45:5 Yor arrows sharp, e dey shuk yor enemies for dia heart and nashons dey fall for yor leg.
45:6 My God, yor throne go dey forever and ever. Na with royal pawa Yu take dey judge yor kingdom.
45:7 Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins. So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head kon make yu high pass any oda pesin.
45:8 Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot. Dem dekorate yor palis with ivory and na harp dem take dey entertain yu for der.
45:9 Kings dota dey join doz wey kom visit yu and yor kween go wear fine-fine gold and silva wey dem make for Ofir town kon stand near yu for yor rite side!
45:10 All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart. Make una forget una pipol and family wey dey far-far.
45:11 Bikos una prince dey happy for una beauti. Make una honor am, bikos na-im bi una oga.
45:12 Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts. Doz wey get money go kom make una help dem.
45:13 Di king dota dey always dey happy for en room afta e don wear en fine-fine klot wey dem make with gold.
45:14 Den dem go take am go meet di king as e wear di fine klot with di virgins wey follow am for back
45:15 and dem go happy dey celebrate as dem dey enter di king palis!
45:16 Dia sons go bi king afta dia papa and dem go rule ova many lands.
45:17 I go make evry generashon honor and remember yor name and pipol go praiz yu forever and ever.