Library · pcm

Psalms 47

47:1 Evribody! Make una kom! Make una klap una hand! Make una shaut praiz God with klean mind! 47:2 Bikos di Most High dey good! Na-im bi di great King for di whole eart. 47:3 E distroy di pipol wey dey before us kon put awa enemies under awa leg. 47:4 E choose and give us di Promise Land as awa propaty for life; di place wey dey make Jakob shidren-shidren happy; di shidren wey God love. 47:5 God dey waka go en throne and pipol dey shaut and blow trumpet as E dey go. 47:6 So, make una sing praiz God; make una praiz am; make una sing praiz to awa King, make una sing praiz am! 47:7 Na God bi di King for all di eart. Make una praiz am with psalms! 47:8 Na God dey rule all di nashons, even as E sidan for en holy throne. 47:9 Di rulers for di world gada togeda with Abraham and God pipol, but bikos na God bi di King of evry king, make una honor am for evriwhere for di world.