Library · pcm

Psalms 48

48:1 Si as awa God great rish! Wi go praiz am for en own town wey dey on-top en holy mountin! 48:2 Di mountin dey high and fine well-well; di whole eart dey happy to si am! Mount Zion wey bi di holy mountin, na-im bi di town where di great King dey stay! 48:3 God ensef dey for Jerusalem towa and na-im dey defend us. 48:4 Di kings for di eart join togeda kon fight di town. 48:5 But wen dem si am, dia heart kut and fear katch dem, so dem kon run go back. 48:6 Fear katch dem well-well and dem kon dey kry with pain like woman wey won born. 48:7 Yu skata dem like di big sheep for Tarshish wey Yu distroy with di wind from east. 48:8 Wi don hear about di town glory, but naw, wi don si am by awasef; di town wey God wey dey lead heaven sojas, dey and bikos na awa God town, E go protet am forever. 48:9 My God, as wi dey woship for yor temple, wi go always dey tok about yor love wey nor dey fail. 48:10 My God, as yor name bi, na so dem go praiz Yu for evriwhere for di eart. Na viktory full yor strong rite hand. 48:11 Make Zion pipol rijoice. Make all di towns for Judah happy, bikos of di way God dey judge. 48:12 Make una go look Jerusalem; waka round and kount all di towas. 48:13 Make una si as di town walls strong rish and as e dey save, den una go fit tell una shidren-shidren about am. 48:14 Bikos na so God bi! Na-im bi awa God and E go guide us forever and ever.