Library · pcm

Psalms 53

53:1 Na fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem don spoil; na bad tins dem dey do and e nor get any one among dem wey dey do good! 53:2 God dey from heaven look evribody; E dey look to si if anybody really get sense and weda anybody really dey find am. 53:3 But nor bi so. Evribody don dey sin; evribody don spoil finish. E nor get anybody wey dey do good at-all! 53:4 Pipol wey dey do wiked tins nor get sense at-all? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor ever dey tink sey e good make dem pray to God. 53:5 Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem. 53:6 Na who go kom from Mount Zion kon save Israel pipol? Wen God don save en pipol, den Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.