Library · pcm

Psalms 54

54:1 My God, make Yu kom with yor great pawa kon save mi! Make Yu defend mi with yor strent. 54:2 My God, make Yu listin to my prayers. Make Yu listin to mi as I dey beg. 54:3 Bikos strenjas dey attack mi; wiked pipol dey try to kill mi and dem nor kare about God. 54:4 But na God dey help mi. Na God dey keep my life! 54:5 Make evry wiked plan wey my enemies dey plan, turn back go meet dem. 54:6 I go just give Yu sakrifice on my own! My Oga God, I go praiz yor name, bikos e dey good and 54:7 Yu save mi from my trobols kon help mi defeat my enemies.