Psalms 57
57:1 My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.
57:2 I kry to di Most High; di God wey dey supply evritin wey I wont
57:3 and E go send help kom from heaven kon save mi, den disgrace doz wey won kill mi. My God go send en goodness and love wey nor dey fail kom.
57:4 Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.
57:5 My God, make Yu raiz pass di sky! Make yor glory shine for evriwhere for di eart.
57:6 My enemies don set trap for mi and I don taya bikos of dia wahala. Dem dig deep pit for where I dey waka pass, but na dem go fall enter by demsef.
57:7 My God, I get hope. Yes! I get hope. So I go sing kon praiz yor name.
57:8 So, make my heart wake-up! Trumpet and jita, make una wake-up too! Mi mysef go wake-up for morning with song for my mout.
57:9 I go tank Yu wey bi my God for where evribody dey. I go sing yor praiz among all di nashons.
57:10 Bikos yor love wey nor dey fail, high pass heaven. Yor faithfulnes dey rish di kloud.
57:11 My God, make Yu raiz pass di sky and make yor glory shine kon kover di whole eart.