Library · pcm

Psalms 58

58:1 Una wey dey rule, una dey judge well? Una dey judge di pipol well so? 58:2 No! Na bad tins una dey plan for una mind and na wahala una dey kause for di whole town. 58:3 Dem born dis wiked pipol with sin for dia heart; na from dia mama belle dem don start to lie and do as dem like. 58:4 Dia spit bi like wiked snake own; dem bi like kobra wey nor dey hear word; 58:5 bikos dem nor won hear di nois wey di pesin wey dey sharm snake, dey make. 58:6 So my God, make Yu break dia tit! Make Yu skata di lion jaw. 58:7 Make dem vanish like wota wey dey flow! Make dem dry like grass wey pipol go burn trowey! 58:8 Make dem bi like snail wey dey die as dem dey waka! Make dem bi like pikin wey dem just born, wey nor ever si sun before e die! 58:9 God go swip dem trowey kwik-kwik, even before pot wey dem put for fire, go dry. 58:10 Pipol wey dey fear God go happy wen dem si wiked pipol dey fall. Dem go use wiked pipol blood take wosh dia legs. 58:11 Den for di end, evribody go sey, “Yes! Pipol wey dey obey God, go get dia reward. True-true, wi get God wey go judge di whole world!”