Library · pcm

Psalms 6

6:1 My God, make Yu nor drive mi, bikos Yu dey vex. Nor ponish mi with yor vexnashon. 6:2 Make Yu sorry for mi, bikos I dey weak. Make Yu heal mi, bikos my bones dey shake. 6:3 I dey fear well-well. Na how e go tey rish, before Yu go kon save mi? 6:4 Make Yu kom back kon help mi. Save mi bikos of yor love wey nor dey fail. 6:5 Pesin wey don die, nor dey remember Yu. Na who go fit praiz Yu from inside grave? 6:6 I don taya to komplain, bikos evry nite, I dey wet my bed with wota from my eyes. 6:7 Sofa don make my eyes blind. My eyes dey weak, bikos of my enemies. 6:8 All of una wey dey do bad tins, make una leave mi alone, bikos God don hear my kry. 6:9 God don hear as I dey beg; E go ansa my prayers. 6:10 So make disgrace follow all my enemies and make dem dey fear well-well! Make dem run turn back, go hide with shame.