Library · pcm

Psalms 7

7:1 My Oga God, I don kom meet Yu make Yu protet mi. So make Yu save mi from doz wey won kill mi! 7:2 If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion and nobody go fit save mi. 7:3 My Oga God, if I don do any wrong tin or dey guilty as dem tok; 7:4 if I sin against my friend or ponish my enemies wen dem nor do anytin against mi, 7:5 den make my enemies porshu and katch mi. Make dem mash mi die kon trowey my body for groun. 7:6 My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies! Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi! 7:7 Pipol for di world gada round Yu, so make Yu rule dem from yor throne. 7:8 Bikos na Yu dey judge evribody, make Yu show sey I dey good, bikos true-true, I dey innocent and na Yu bi di Most High God! 7:9 Make Yu stop di bad tins wey wiked pipol dey do kon defend doz wey dey good, bikos my God wey dey good, know wetin dey pipol mind and heart. 7:10 Na God bi my guide! E dey save doz wey get klean and true heart. 7:11 God dey judge well. E dey vex for wiked pipol evriday. 7:12 If pesin nor gri turn from sin kom meet God, God go sharp en swod kon ready to shot en bow. 7:13 E go ready en swod wey dey kill kon shot en arrow wey dey hot like fire. 7:14 Pesin wey karry wikedness and bad plans for belle, dey born lie-lie. 7:15 E dey dig deep pit for odas, but na en ensef dey fall enter 7:16 and di trobol wey e plan for odas, dey fall for en own head. Na en own wahala dey kause trobol for am. 7:17 So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.