Library · pcm

Psalms 60

60:1 My God, Yu don rijet and skata awa defence, bikos Yu dey vex for us. But naw, make Yu kom favor us again. 60:2 Yu shake di eart kon tear am into two. So, make Yu join where divide, bikos di eart don dey fall. 60:3 Yu dey trit us with strong hand kon make us drink wine wey dey katch us naw. 60:4 But Yu don give one banner to pipol wey dey fear Yu, so dat dem go dey save wen enemies attack dem. 60:5 Naw, make Yu save yor pipol wey Yu love. Make Yu ansa kon save us with yor pawa. 60:6 God don tok from en holy place sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley. 60:7 Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings. 60:8 But Moab wey I dey use as my wosh-hand basin, go bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.” 60:9 So, who go take mi enter di strong town? Who go fit help mi win Edom pipol? 60:10 My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go war again? 60:11 Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help dey yuzles. 60:12 But with awa God help, wi go get viktory, bikos E go help us mash awa enemies for groun kon win dem.