Psalms 61
61:1 My God, make Yu hear as I dey kry! Make Yu hear mi as I dey pray for help!
61:2 From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save.
61:3 True-true, na Yu dey save mi; my strong towa wey dey protet mi from my enemies.
61:4 Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu.
61:5 Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.
61:6 Mi wey bi king, make Yu give mi long life, so dat I go si my shidren-shidren!
61:7 Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.
61:8 Den, I go dey sing praiz yor name forever kon dey do wetin I promise Yu.