Psalms 65
65:1 My God wey dey Zion, na betta praiz dey wait Yu, bikos yor pipol dey do wetin dem promise.
65:2 Bikos Yu hear and ansa awa prayers; so evribody go kom meet Yu.
65:3 Awa sins too many, so Yu don forget us, bikos wi nor dey hear word.
65:4 But blessing go follow di pesin wey Yu choose to stay yor palis. Make di good tins wey dey yor house, yor holy place, beleful us.
65:5 Yu really ansa awa prayers wen Yu show us how Yu take dey save and diliver us. Di whole eart trust Yu; plus pipol wey dey di oda side for di sea.
65:6 Yu kreate di mountins with yor strent kon show as yor pawa strong rish.
65:7 Yu make di rof sea kwayet kon silent di nashons wey dey kause trobol.
65:8 Even pipol wey dey far from awa land, dey sopraiz for yor greatness and Yu make doz wey dey stay for east and west, praiz Yu.
65:9 Yu visit di eart kon make rain fall put, so dat e go dey good kon produce plenty food. Yu make wota full di sea and di land dey bring betta food, bikos Yu don kommand sey na so e go bi.
65:10 Yu dey wet di dry groun with rain, so dat di soil go soft and seeds go grow well.
65:11 Yu crown di year with yor good blessing and even where hard pass, still dey produce plenty food.
65:12 Di grass for wildaness dey fresh and di hill dey shine with joy.
65:13 Na animals full di fields and na betta food full di valley. Evritin dey sing and shaut for joy!