Library · pcm

Psalms 66

66:1 Make di whole eart shaut with joy as dem dey praiz God! 66:2 Make una sing about di glory wey en name dey bring! Make una tell di world how en glory big rish. 66:3 Make una tell God, “Si as di tins wey Yu do dey great. Yu skata yor enemies with yor strong pawa! 66:4 Evritin for eart go woship Yu; dem go sing yor praiz kon dey shaut for glory as dem dey koll yor name.” 66:5 Make una kom si wetin God don do; di wonderful mirakles wey E do among en pipol! 66:6 E turn di Red Sea to dry land and en pipol kon dey happy as dem dey waka pass di dry groun. 66:7 Na en great pawa E take dey rule forever. E dey si evritin wey di nashons dey do; so make wiked pipol nor dey karry body. 66:8 Make di whole world bless awa God! Make dem shaut tell evribody about en praiz. 66:9 Awa life dey en hand and E nor let us fall. 66:10 My God, Yu don test and make us klean like silva. 66:11 Before-before, Yu katch us for yor net kon make us sofa well-well. 66:12 Yu allow men rule us; wi dey pass thru fire and wota, but naw, Yu don bring us kom where dey save. 66:13 I go enter yor temple with sakrifice; I go do di tins wey I promise Yu; 66:14 di vow wey I tok with my mout and my lip wen I dey trobol. 66:15 I go give Yu fat animals as burnt ofrin, plus di smell from ram wey dem sakrifice. I go give Yu melu and goats. 66:16 Kom! All of una wey dey loyal to God, make una listin as I dey tok wetin E do for mi! 66:17 I kry to am make E help mi kon praiz am with my tongue. 66:18 If I gada sin for my heart, God nor go ansa or listin to mi. 66:19 But God dey hear and listin to my prayers. 66:20 Na God get all di praiz, bikos E nor rijet my prayers and E still dey show mi en love wey nor dey fail!