Psalms 71
71:1 My God, I don run kom meet Yu make Yu protet mi; so nor let dem disgrace mi.
71:2 Make Yu kom take and save mi, bikos Yu dey do wetin dey rite. Make Yu listin and diliver mi.
71:3 Make Yu bi my Savior and di Rock where I go always hide put. Give kommand make dem save mi, bikos Yu bi my rock and di place where I dey hide put.
71:4 My God, save mi from wiked pipol pawa and from doz wey dey opress mi,
71:5 bikos na only Yu bi my hope and na from wen I bi small pikin, I don dey trust Yu kom rish naw.
71:6 Yes! Yu don dey with mi since wen dem born mi and Yu dey kare for mi from my mama belle. No wonder I dey always praiz Yu!
71:7 My life na ezample to many pipol, bikos na Yu bi my strent and proteshon.
71:8 Dat na why I nor fit stop to praiz Yu and I go dey tok about yor glory evriday.
71:9 Naw, for my old age, make Yu nor rijet mi. Make Yu nor leave mi wen I nor dey strong again.
71:10 My enemies dey gossip mi. Dem dey plan how dem go take kill mi.
71:11 Dem dey sey, “God don rijet am. So make wi go katch am, bikos nobody go help am again.”
71:12 So, my God, make Yu nor leave mi, but make Yu hurry kom save mi.
71:13 Make Yu disgrace and distroy pipol wey dey akuiz mi. Make disgrace and shame follow pipol wey won kill mi.
71:14 But for mi, I go always dey wait for yor help and I go dey praiz Yu more and more.
71:15 I go tell evribody about yor raitiousness and evriday, I go always dey tok about di pawa wey Yu take dey save, even doh I nor really fit esplain how e bi.
71:16 My God wey get pawa, I go praiz Yu bikos of all di great tins wey Yu don do. I go tell evribody sey na only Yu dey do good.
71:17 My God, na from wen I bi small pikin, Yu dey tish mi yor ways and I always dey tell pipol about di wonderful tins wey Yu don do.
71:18 Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi. Make I tell dis new generashon and all doz wey dey porshu mi about yor pawa.
71:19 My God, yor good judgement dey rish di heavens and Yu don do many wonderful tins, so na who bi like Yu?
71:20 Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.
71:21 I know sey Yu go karry mi put for where dem go for honor mi well, so make Yu turn kon konfort mi.
71:22 Den I go praiz Yu with harp, bikos Yu dey faithful to yor promise. My God, I go use jita take sing praiz Yu wey bi di Holy One for Israel.
71:23 I go shaut for joy kon sing with praiz, bikos Yu don save mi
71:24 and till I die, I go always dey tell pipol about yor good works, bikos evribody wey dey try to kill mi, Yu don disgrace and make shame katch dem.