Psalms 72
72:1 My God, I beg Yu! Make Yu give di king di sense to dey judge well! Always allow di king pikin dey tok wetin dey korrect!
72:2 Den e go judge yor pipol and doz wey dem dey opress, well.
72:3 Di mountin go karry peace news kom meet yor pipol and di hills go tok about korrect judgement.
72:4 E go defend doz wey dem dey opress among di pipol, diliver poor pipol shidren and distroy doz wey dey opress pipol.
72:5 As long as di sun and moon dey di sky, pipol go always dey fear Yu from one generashon go rish anoda.
72:6 Wen di king dey rule, e go bi like wen rain fall on-top grass wey dem kut; e go bi like rain wey dey wota di groun.
72:7 All di pipol wey dey fear God go prosper as di king dey rule. So make goodness follow dem, as long as di moon dey shine for di sky.
72:8 Make di king rule from sea go rish sea and from Eufrates River go rish di end for di eart.
72:9 Desert go bow before am; en enemies go fall for groun for en front.
72:10 Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.
72:11 All di kings go bow for am and all di nashons go serve am.
72:12 Di King go save poor pipol wen dem kry kom meet am kon help doz wey dem dey opress and doz wey nor get who go fight for dem.
72:13 E go pity for doz wey dey weak and poor kon save dem.
72:14 Bikos dia life dey important to am, e go save dem from pipol wey dey opress and kause wahala for dem.
72:15 Di king go live forever! Dem go dey gi-am gold from Sheba and di pipol go always dey pray and bless am evriday.
72:16 Food go many for di land and seeds go even dey grow well on-top mountins. Make trees bear betta fruit like di trees for Lebanon and make pipol for di land dey grow well like betta grass for di field.
72:17 Make di king rule forever; make en kingdom kontinue as long as di sun dey shine. Make blessing dey all di nashons bikos of am, so dat dem go praiz am.
72:18 Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.
72:19 Make una praiz en name wey get glory forever! Make en glory dey di whole eart. Amen!
72:20 David wey bi Jesse pikin, na here en prayers for end.