Library · pcm

Psalms 74

74:1 My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field? 74:2 Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world; di tribe wey Yu take as yor own! Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay. 74:3 Make Yu waka round di town wey dem skata; den Yu go si as di enemies distroy yor temple. 74:4 Na for der yor enemies dey shaut and sing sey, “Dem don win.” Na der dem for stand dia war flag. 74:5 Dem dey use dia axe like doz wey dey kut wood for bush. 74:6 Dem use axe and knife take skata evritin wey dem karve 74:7 kon burn yor temple rish groun. Yes, dem distroy di place wey dey ansa yor name. 74:8 Den dem kon dey boast dey sey, “Make wi distroy evritin!” So dem burn evriwhere wey wi for dey woship God. 74:9 Naw, wi nor dey si yor mirakles again. All di profets don die and nobody fit tell us wen dis wahala go end. 74:10 So God, na how long e go take before Yu go stop awa enemies wey dey curse us? Yu go let dem take yor name make yeye forever? 74:11 Wetin make Yu nor won use yor strong rite hand against dem? Make Yu kom distroy dem finish. 74:12 But Yu God don bi my King since my grand-grand papa dem time and Yu dey save us for dis world. 74:13 Yu divide di sea with yor pawa kon kill di monsta wey dey der. 74:14 Yu skata di wota juju head kon allow animals for desert chop am. 74:15 Just as Yu get pawa to make wota and sea flow, na so too, Yu fit dry river wey nor suppose dry. 74:16 Na Yu get both day and nite; na Yu still make di moon and di sun. 74:17 Yu measure where di eart go rish kon make both dry and rainin sizin. 74:18 My God, si as di enemies dey curse Yu. Pipol wey nor get sense nor dey respet yor name. 74:19 Make Yu nor let dis wiked animal distroy yor pipol. Yor pipol wey dey sofa, make Yu nor forget dem forever. 74:20 Make Yu remember yor kovenant, bikos na darkness and trobol full di land! 74:21 Make Yu nor let dem disgrace pipol wey dey sofa. Instead, make Yu let poor pipol and doz wey dem dey opress, praiz yor name. 74:22 My God, make Yu raiz-up kon fight for mi. Make Yu remember as dis fools dey curse Yu evriday. 74:23 Make Yu nor forget evritin wey yor enemies tok or how dem dey shaut anyhow.