Psalms 73
73:1 True-true, God dey good to Israel pipol and to doz wey dia heart dey pure.
73:2 But for mi, my heart almost fail mi and my faith don nearly vanish,
73:3 bikos I dey jealous proud pipol wen I si dem dey prosper, even doh dem wiked.
73:4 E bi like sey dem dey enjoy life and dia body dey fresh and strong.
73:5 Dem nor dey face trobol like oda pipol or si wahala like evry oda pesin.
73:6 Dem wear pride like shain for neck kon wear yanga like belt for waist.
73:7 Dia money dey make dem do wiked tins and na bad-bad tins dem dey always tink about.
73:8 Evritin wey dem dey do and tok, na only about wiked tins and as dem dey proud, evritin wey dem wont, na to kill oda pipol.
73:9 Dem dey boast like sey dem dey stay heaven and dey bihave like sey na dem get di world,
73:10 so even God pipol dey bilive evritin wey dis wiked pipol dey tok.
73:11 Dem dey ask, “How God won take know wetin wi dey do? Di Most High even know wetin dey happen so o-o?”
73:12 Si dis wiked pipol dey enjoy life, bikos dia money dey plenty.
73:13 So I konklude for my heart sey, “I just get klean heart for nor-tin! I just dey innocent and nor dey do bad tins for no rizin!
73:14 Na only trobol I dey always get and evry morning dey kause pain for mi.”
73:15 If to sey I don tok dis tins wey I dey tink, I for don betray doz wey dey obey Yu.
73:16 So, even wen I try to undastand while wiked pipol dey prosper, e dey konfuse mi di more!
73:17 Den I enter inside di temple go ask my God and E show mi en plans for wiked pipol.
73:18 True-true, God put dem for di road wey dem go for fall kon make di groun for di hill wey go distroy dem, draw dem fall.
73:19 Na wons God go take distroy and trowey dem down with fear.
73:20 So my God, wen Yu raiz-up, Yu go laf dia yeye plan; wey bi like dream wey dey vanish wen day break.
73:21 Yes, my heart dey bitter and I dey feel pain for inside my body.
73:22 I bin dey do like fool wey sturbon. I know sey for yor present, I bin look like animal wey nor get sense.
73:23 Yet, I still bilong to Yu and Yu hold my rite hand.
73:24 Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.
73:25 Na who I get for heaven escept Yu? I wont Yu more dan anytin for dis eart.
73:26 My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.
73:27 So doz wey nor dey fear am go die, bikos E dey distroy doz wey turn from am.
73:28 But for mi, si as e good to dey near God! I don make di God wey get pawa my guide and I go tell evribody about di wonderful tins wey E don do.