Psalms 76
76:1 God don show ensef to Judah pipol. En name dey great among Israel pipol.
76:2 Na Jerusalem E dey stay and na Mount Zion bi en house.
76:3 Na der E for break di enemies wiked arrow, dia guide, swod and all di tins wey dem take dey fight.
76:4 En glory and majesty dey shine as E dey kom from di mountin where E for kill en enemies.
76:5 Awa strong enemies don skata. Dem don sleep kon die go like dat, so nobody go fit fight us again.
76:6 My Oga wey bi Jakob God, wen Yu breath, all yor enemies horse and shariot dey fall die.
76:7 No wonder dem dey fear Yu well-well! Na who fit stand for yor front wen Yu dey vex?
76:8 Na from heaven Yu dey judge yor enemies; di eart dey shake and dem dey kwayet for yor present.
76:9 My God, Yu dey judge di pipol wey dey do wiked tins kon save doz wey dem dey opress for dis world.
76:10 True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.
76:11 So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise. Make evribody bring gift kon give di Holy One!
76:12 E dey honbol prince and kings for dis eart, dey fear am.