Psalms 77
77:1 I shaut and kry to my God; yes I shaut and E hear mi!
77:2 Wen I dey trobol, I look for God. Thru-out di nite, I pray and lift my hand go heaven, but nor-tin fit konfort my soul.
77:3 Wen ever I tink of God, na kry I always dey kry make E kom help mi.
77:4 Yu nor dey let mi sleep and I too dey weak to pray!
77:5 I bin dey tink of di good days before-before,
77:6 wen betta song with joy full my nite. But naw, I dey look my life kon dey tink and si how e dey difren.
77:7 So God don rijet mi forever? E nor go ever show mi en love again?
77:8 En love wey nor dey fail don go forever? E promise don fail finish?
77:9 God don forget to dey sorry for pesin? E don klose di door to pipol wey dey kom meet am for help?
77:10 So I kon sey, “Na mi kause am! Na mi let God turn en hand against mi”
77:11 But my Oga God, I remember evritin wey Yu don do. I remember all di wonderful tins wey Yu do before.
77:12 Dem always dey my mind and I nor fit stop to dey tink about di mighty tins wey Yu do.
77:13 My God, yor ways dey holy. E get any god wey get pawa like Yu?
77:14 Na Yu bi God wey dey do great wonders! Yu dey show yor great pawa among di nashons.
77:15 With yor hand, Yu save yor pipol wey bi Jakob and Josef shidren-shidren.
77:16 My God, wen di Red Sea si Yu, di wota kon dey fear and di sea shake rish bottom.
77:17 Rain fall kom down from di kloud and tonda nois full di sky, den yor arrow with lite kon dey shine.
77:18 Dem hear yor vois like tonda from di strong wind, di lite make di world dey shine and di world kon dey shake with fear.
77:19 Yu waka on-top di sea go diliver yor pipol kon strol pass di great river, but nobody fit si yor footstep bikos e nor show at-all.
77:20 Den Yu use Moses and Aaron take lead and guide yor pipol like many sheep.