Psalms 79
79:1 My God, strenjas don take di land wey Yu choose as yor own. Dem don spoil yor holy temple kon turn Jerusalem to where dem dey pour dirty put.
79:2 Dem don kill yor savants kon leave dia body for groun make bird chop dem. Doz wey dey fear Yu, dia flesh don turn food for wild animals.
79:3 Blood dey flow like wota for evriwhere for Jerusalem and nobody remain wey go beri doz wey dem kill.
79:4 Awa neighbours dey laf us; pipol wey dey around us, dey take us make yeye.
79:5 My God, na how long Yu go dey vex with us? Na forever? Na how long yor vexnashon go dey burn like fire?
79:6 Make Yu pour yor vexnashon for di nashons wey nor dey respet Yu; di kingdoms wey nor dey koll yor name,
79:7 bikos dem don finish yor pipol Israel kon turn di land to dirty and empty wildaness.
79:8 Make Yu nor kount awa grand-grand papa dem sin against us and bikos Yu dey sorry for pipol, make Yu kwik-kwik kom ansa us, bikos e remain small make wi die finish.
79:9 My God wey dey save us, make Yu kom help us! Make Yu forgive us, bikos of di glory wey dey yor name.
79:10 Wetin make Yu allow wiked pipol even get mout to ask sey, “Where dia God dey?” Make Yu revensh dis pipol, bikos dem don kill yor savants finish.
79:11 Make Yu listin to di prisonas kry. Make Yu show yor great pawa kon save doz wey pipol sey dem must die.
79:12 My God, make Yu pay awa neighbours seven times for di mout wey dem don take boast for Yu.
79:13 Den, wi yor pipol, di sheep for yor field, go tank Yu forever kon dey praiz yor name from one generashon go rish anoda.