Library · pcm

Psalms 78

78:1 My pipol, make una listin to wetin I dey tok. Make una open una ear, so dat una go hear wetin I dey tell una, 78:2 bikos na parabol I go take tok to una. I go tish una about some tins wey don happen before; 78:3 story wey awa grand-grand papa dem tell us. 78:4 Wi nor go hide dis trut from awa shidren; wi go tell di next generashon about di good-good tins wey God do, en pawa and di wonderful tins wey dey sopraiz us. 78:5 E give law to Jakob shidren kon tell en pipol Israel, wetin dem go do. E still kommand awa grand-grand papa sey make dem tish di laws to dia shidren, 78:6 so dat di next generashon go know; even di shidren wey dem neva born and dis ones too go tish dia own shidren. 78:7 So evry generashon go get hope and trust God and dem nor go forget en great mirakles, but dem go obey en kommand. 78:8 Dem nor go bi like dia grand-grand papa wey sturbon; pipol wey nor gri obey, listin or give dia heart to God. 78:9 Efraim sojas, even doh dem get bow and arrow, wen war start, dem go run, 78:10 bikos dem nor gri keep God kovenant or obey en kommandment. 78:11 Dem forget wetin E don do, di great wonders wey E show dem, 78:12 di mirakles wey E do for dia grand-grand papa for Zoan wey dey for Egypt. 78:13 For der, E divide di sea kon take dem pass as di wota stand up like wall! 78:14 E dey lead dem with kloud for day and pila wey get fire for nite. 78:15 E tear rock open kon give dem wota drink for wildaness! 78:16 E make wota kom out from di rock and e kon dey flow like river! 78:17 Yet dem still dey sin against am; dey disobey di Most High for di desert. 78:18 Dem dey test God with sturbones for dia heart kon dey tok di kind food wey dem won chop. 78:19 Dem even tok against God ensef wen dem sey, “God nor fit give us food for di wildaness. 78:20 Yes! E fit nak rock make wota kom out, but E nor fit give en pipol bread and meat.” 78:21 Wen God hear dem, E vex well-well. Di fire from en vexnashon kon dey against en pipol. Yes! En vexnashon kon strong well-well, 78:22 bikos dem nor gri bilive God or trust sey E go kare for dem. 78:23 But E kommand di sky make e open, den E open di doors for heaven. 78:24 E send manna kom down so dat en pipol go si food chop; E give dem bread from heaven. 78:25 Dem chop food wey angels dey chop and God give dem enough to chop. 78:26 God release di east wind for heaven kon guide di sout wind with en pawa. 78:27 E send meat like dust go give dem kon still give dem birds wey plenty like san-san wey dey wotaside! 78:28 E make di birds dey fall for evriwhere for dia kamp and for dia house 78:29 and di pipol chop beleful. E give dem wetin dem ask for. 78:30 But before dem even beleful, as di meat still dey dia mout, 78:31 God kon dey vex for dem and E kill all dia strong-strong men. E kill Israel yong men wey fine pass. 78:32 But even as all dis tins dey happen, di pipol still dey sin. With all dis mirakles, dem nor gri trust am. 78:33 So E kon make dem die with disgrace and dia years kon end with shame. 78:34 Wen God dey kill dem, dem kon dey beg make E sorry for dem. Dem turn to God kon take am sirious. 78:35 Den dem remember sey na God bi dia rock; sey na di Most High God save dem. 78:36 But dem dey lie give God kon dey tok anyhow. 78:37 Dia heart nor dey loyal to God and dem nor gri keep en kovenant. 78:38 Yet, God sorry for dem kon forgive dem dia sins and E nor distroy all of dem. So, E nor dey too vex for dem or show en vexnashon, 78:39 bikos E remember sey na ordinary human being dem bi. Dem go just die go like breeze wey nor dey kom back again. 78:40 Dem sin against am many times for di wildaness kon make am vex for dat dry dirty land. 78:41 Dem always dey test and shalenge God. Dem dey make di Holy One for Israel dey vex. 78:42 Dem nor remember en pawa and how E save dem from dia enemies. 78:43 Dem nor remember all di mirakles wey E do for Egypt; di wonders wey E do for Zoan field, 78:44 bikos E turn Egypt river to blood, so dat nobody go fit drink di wota. 78:45 E send many fly kon attack dem and many frog skata dia land. 78:46 E allow katapiller chop dia plants and lokust chop all dia seed. 78:47 E distroy dia grape vine with big-big stones kon skata dia sykamore-fig tree. 78:48 E kill and distroy dia animals with big-big stone and strong tonda. 78:49 E show dem en great vexnashon and anga. E send angels wey dey distroy tins go meet dem. 78:50 E turn en vexnashon face dem. E nor sorry for Egypt pipol life, but E use strong wahala take distroy dem. 78:51 E kill all di first sons for Egypt family; all di first sons wey Egypt pipol born. 78:52 But E lead en own pipol kom out like many sheep kon guide dem pass di wildaness. 78:53 E guide and keep dem as dem dey go; but di sea kill dia enemies. 78:54 E bring dem kom di borda for en holy land; di hill lands wey E don win for dem. 78:55 E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house. 78:56 But Israel pipol still dey test and sin against di Most High God and dem nor gri obey en laws. 78:57 Dem turn back and dem nor kon get faith like dia papa and mama. Yu nor fit put hope on dem, bikos dem bi like bow wey don spoil. 78:58 Dem dey make God vex as dem dey build shrine for oda gods; dem really make God jealous with dia juju. 78:59 Wen God hear dem, E kon dey vex and E really rijet Israel pipol. 78:60 Den E leave en place for Shiloh, di Tabanako where E bin dey stay with en pipol. 78:61 E allow enemies karry en Kovenant Box kon give dem en glory. 78:62 E give en pipol to enemies make dem kill dem with swod, bikos E dey vex well-well with di pipol wey E love well-well. 78:63 Na fire kill dia yong men and dia yong wimen die even before dem sing dia wedding song. 78:64 Dem kill dia priests and wimen wey dia husband don die, nor fit mourn for dem. 78:65 Den God raiz-up like sey E just dey wake from sleep; like strong soja wey en eye just klear from drink. 78:66 E skata en enemies kon disgrace dem forever. 78:67 But E rijet Josef shidren-shidren and E nor gri support Efraim tribe again. 78:68 Instead, E choose Judah tribe and Mount Zion wey E love. 78:69 E build temple wey high like heaven kon strong like di eart, den E put am for der. 78:70 E choose David en savant, wen E koll am from where e for dey kare for sheep. 78:71 E take David from where e for dey kare for animals kon make am leader among Jakob shidren-shidren, wey bi Israel God own. 78:72 E kare for dem with betta mind kon save dem with en strong hand.