Library · pcm

Psalms 85

85:1 My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back. 85:2 Yu forgive yor pipol dia sins. Yes! Yu kover all dia sins. 85:3 Yu nor dey vex for dem again and Yu nor show dem yor vexnashon. 85:4 My God wey dey diliver us, make Yu save us again! Make Yu nor dey vex for us! 85:5 Abi Yu go dey vex for us forever? Yu go just dey vex even for awa shidren-shidren? 85:6 Yu nor go revive us again so dat yor pipol go happy bikos of Yu? 85:7 My God, make Yu show us yor loyal love! Pour yor salvashon for awa head! 85:8 I go listin to wetin Oga God tok, bikos E go make peace with en pipol; doz wey dey obey am, so-far dem nor go-go back to dia wiked and yeye ways. 85:9 True-true, time dey kom wen pipol wey dey follow am well, go si en salvashon; den en glory go appear for di land again. 85:10 Love wey nor dey fail and trut, don join togeda. Raitiousness and peace don kiss each oda. 85:11 Trut dey kom out from di world and raitiousness dey smile kom down from heaven. 85:12 Yes, God dey pour en blessings kom down, so awa land go produce betta-betta food again. 85:13 Raitiousness dey go for God front go prepare di way wey E go pass.