Psalms 86
86:1 My God, make Yu hear my prayer; make Yu ansa and help mi, bikos pipol dey opress mi.
86:2 Make Yu protet and save mi, bikos na only Yu I dey serve and trust and na Yu bi my God.
86:3 Make Yu sorry for mi, my Oga God, bikos I dey always koll yor name.
86:4 My God, make Yu make mi happy, bikos I don give mysef to Yu.
86:5 Yu dey good and ready to forgive awa sins and pipol wey kom meet Yu for help, Yu dey show dem yor love wey nor dey fail.
86:6 So my God, make Yu listin well-well to my prayers; make Yu kwik-kwik hear mi as I dey kry for help.
86:7 I go koll Yu wen ever I dey trobol and Yu go ansa mi.
86:8 My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!
86:9 Oga God, all di nashons wey Yu make, go kom bow down for Yu and dem go praiz yor holy name,
86:10 bikos Yu big well-well and dey do wonderful tins. Na only Yu bi God,
86:11 so make Yu tish mi yor ways, so dat I go live my life as Yu wont am! Make Yu give mi pure heart, so dat I go always dey honor Yu.
86:12 My Oga and God, I go praiz Yu with all my heart, I go give glory to yor name forever,
86:13 bikos di love wey Yu get for mi, big well-well and Yu don save mi from deat.
86:14 My God, wiked pipol dey raiz against mi; sturbon pipol dey won kill mi. Yu nor mean anytin to dem!
86:15 But Yu, my Oga, Yu bi God wey dey sorry and pity for pipol; Yu nor dey kwik vex and Yu dey show yor faithfulnes and great love wey nor dey fail.
86:16 Make Yu turn face mi kon sorry for mi! Make Yu give yor pawa to yor savant, den diliver pipol wey dey obey Yu.
86:17 Make Yu show mi sign sey Yu go favor mi. Den shame go katch di pipol wey hate mi, bikos Yu wey bi my God, don help and konfort mi.