Library · pcm

Psalms 88

88:1 My Oga God wey dey save mi. For day time, I dey kry give Yu and I still dey pray to Yu for nite. 88:2 Abeg, make Yu hear my prayer; make Yu listin to mi as I dey kry, 88:3 bikos na so-so trobol full my life and deat don near mi well-well. 88:4 I don already bi like pesin wey don die; like strong man wey nor get pawa again. 88:5 I bi like who dey among dead body and I sleep like sey I dey grave. Yu don forget mi and Yu nor kare for mi again. 88:6 Yu don trow mi enter deep pit kon keep mi for di place wey dark well-well. 88:7 Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi. 88:8 Yu don porshu my friends kon fool mi for dia front and naw, I dey for trap wey I nor go fit run komot. 88:9 My own tears don blind my eyes. My God, evriday I dey beg make Yu kom help mi; I lift my hand to Yu make Yu sorry for mi. 88:10 All di wonderful tins wey Yu dey do nor mean anytin to pipol wey don die. Abi dead body go fit raiz-up kon praiz Yu? 88:11 Pipol wey dey grave go fit tok about yor love wey nor dey fail? For where dem dey naw, dem go fit tok about how Yu good rish? 88:12 Darkness go fit tok about di wonderful tins wey Yu do? Dead body go fit tok about di good-good tins wey Yu dey do? 88:13 My God, I dey kry give Yu and I go kontinue to beg Yu evriday by day. 88:14 So, my God, wetin make Yu rijet mi? Wetin make Yu turn yor face from mi? 88:15 Na since wen I dey small Yu allow pipol dey opress mi and I don nearly die. Yu don ponish mi well-well and naw, na pains full my life. 88:16 Di way Yu dey vex, dey make mi sopraiz. Yes! Yor vexnashon don distroy mi finish. 88:17 Evriday, pipol gada round mi like wota kon join togeda dey opress mi. 88:18 Yu don allow pipol wey I love and doz wey love mi, dey run from mi. So, na darkness bi my best friend naw.