Psalms 89
89:1 I go always dey sing about God love wey nor dey fail! Both yong and old pipol go hear about how God good rish.
89:2 Yor love wey nor dey fail go last forever. Yor goodness dey forever like di heavens.
89:3 God sey, “I don make kovenant with David, my savant wey I choose. I don promise am sey:
89:4 ‘I go make en shidren-shidren king forever; dem go sidan for di throne from naw go rish wen di world go end.’ ”
89:5 So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do and angels go praiz Yu bikos of how Yu dey good.
89:6 My God, na who pipol won take kompare Yu for all di heavens? E get any angel wey bi like God?
89:7 Even angels dey honor am wen dem gada togeda and E great pass evribody wey dey round en throne.
89:8 My Oga God wey dey rule evriwhere! Nobody dey strong like Yu, bikos Yu always dey do good.
89:9 Na Yu dey rule di sea and kontrol dia waves.
89:10 Yu distroy and kill Rahab and Yu skata all yor enemies with yor mighty hand.
89:11 Na Yu get di heavens and di eart; evritin wey dey di eart na yor own, bikos na Yu kreate all of dem.
89:12 Na Yu kreate di nort and sout. Mount Tabor and Mount Hermon dey praiz yor name.
89:13 Pawa dey yor hand; yor hand strong well-well! Wons Yu raiz yor rite hand wey get pawa, Yu dey always dey win.
89:14 Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail.
89:15 Pipol wey dey woship Yu, dey always dey happy; dem go waka for di lite wey dey yor present, bikos Yu don favor dem.
89:16 Dem dey happy evriday bikos of di wonderful tins wey Yu dey do and yor raitiousness dey save dem.
89:17 Na Yu bi dia strent and glory and e dey sweet Yu to make us strong and bikos Yu favor us, wi dey always win.
89:18 Yes! Awa proteshon dey kom from God and na en wey bi di Holy One for Israel, bi awa king.
89:19 Before-before, Yu tok thru vishon to pipol wey dey obey Yu. Yu sey, “I don choose sojas and I don selet one yong man from di pipol as king.
89:20 I don si my savant David and I don anoint am with my holy oil.
89:21 I go support am with my hand and with my hand wey get pawa, I go make am strong.
89:22 En enemies nor go fit win am and wiked pipol pawa nor go fit opress am.
89:23 I go distroy pipol wey dey tok against am kon kill doz wey hate am.
89:24 My goodness and love wey nor dey fail, go dey with am and with my authority, e go grow with pawa.
89:25 I go make am rule many kingdoms and en pawa go strong well-well.
89:26 Den e go koll mi kon sey, ‘Yu bi my Papa, my God and di Rock wey dey save mi.’
89:27 I go make am my first-born and bikos I choose am as king, na-im pipol go praiz pass for di whole world.
89:28 I go love and dey kind to am forever and my kovenant with am, nor go ever end.
89:29 I go gi-am one son wey go take-ova from am and just as di days for heaven nor dey end, na so too en kingdom nor go ever end.
89:30 But if en shidren-shidren nor gri listin to my kommand and disobey my laws;
89:31 if dem nor gri follow my ways or do wetin I tok,
89:32 I go ponish dem with rod kon flog dem with kane, bikos of dia sturbones and sins.
89:33 But I nor go stop to love am or forget di promise wey I make with am.
89:34 No! I nor go break my promise; I nor go take back one singol word wey I tok.
89:35 Yes! I don promise David and bikos I dey holy, I nor go fit lie:
89:36 en shidren-shidren go bi king forever and en kingdom go dey forever like di sun.
89:37 E go dey forever like di moon and di sky go bi witness to show how I really dey faithful!”
89:38 But naw, God, Yu don rijet and porshu David shidren-shidren. Yu dey vex with di king wey Yu anoint.
89:39 Yu don forget di kovenant wey Yu make with am kon trow en crown for dust.
89:40 Yu don break di wall wey dey guide am kon distroy evritin wey dey protet am.
89:41 Anybody wey dey pass, dey tif from am and en neighbours don take am dey do yeye.
89:42 Yu don give en enemies pawa kon make dem dey happy.
89:43 Yu make sure sey en swod nor mean anytin and Yu nor gri help am for war again.
89:44 Yu don end en glory kon trowey and skata en throne.
89:45 Yu don make am old before en time kon disgrace am for publik.
89:46 So, my God, na how long dis tins go happen? Yu go hide yor face forever, abi Yu go just dey vex like dat?
89:47 Make Yu remember how my life short rish and how human being life empty and nor mean anytin!
89:48 Evribody go die, bikos nobody fit stay forever and nobody go fit run from grave pawa.
89:49 So my God, where all di good tins wey Yu bin do for us; di ones wey Yu do just as Yu promise David?
89:50 Make Yu konsida how dem dey disgrace yor savant and how I go must bear all di curse wey pipol dey curse mi.
89:51 Yor enemies dey laf and fool mi. Anywhere wey di king wey Yu anoint go, na so-so laf dem dey laf am.
89:52 But with all dis tins wey dey happen, na God wi go praiz forever and ever! Amen and Amen!