Psalms 9
9:1 My God, I go tank Yu with all my heart; I go tok about all di wonderful tins wey Yu don do.
9:2 I go sing with joy bikos of Yu. Di Most High God, I go sing praiz yor name,
9:3 bikos as my enemies si Yu, dem stagga fall kon die.
9:4 Naw, yor judgement don favor mi and Yu don judge well from yor throne.
9:5 Yu make di nashons dey fear kon distroy wiked pipol, den Yu remove dia name from yor book forever.
9:6 My enemies don die finish forever; di towns wey Yu rut komot from groun, dem nor go ever remember dem again.
9:7 But God go reign forever and E go dey judge from en throne.
9:8 E go judge di world well kon rule di pipol with betta mind.
9:9 Na God dey guide doz wey dem dey opress; na-im dey save dem wen trobol kom.
9:10 Doz wey dey loyal to Yu, dey trust Yu, bikos Yu nor dey leave doz wey wont make Yu help dem.
9:11 E good make wi sing praiz to God wey dey rule from Jerusalem. Make wi tell di world all di tins wey E do, wey dem nor fit forget.
9:12 Bikos di Pesin wey dey ponish doz wey kill pipol, still dey kare for doz wey nor get helpa. E nor dey leave pipol wey dey sofa.
9:13 My Oga God, make Yu sorry for mi. Si as my enemies dey trobol mi, so make Yu kom take mi komot from deat mout.
9:14 Save mi so dat I go fit praiz Yu for publik for Jerusalem gate. Yes! I go dey happy bikos Yu don save mi.
9:15 Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.
9:16 Dem don know God naw, bikos E dey judge well and naw, wiked pipol dey fall enter dia own trap.
9:17 Wiked pipol go die enter grave. Dis na wetin go happen to all di pipol wey rijet God.
9:18 But God nor go forget doz wey dey kry for help. E nor go live dem forever; E go always dey give poor pipol hope.
9:19 My Oga God, make Yu raiz-up! Nor let wiked pipol win! Make Yu kom judge di nashons.
9:20 Make dem fall with fear. Make Yu let pipol know sey, na ordinary human being dem bi.