Library · pcm

Psalms 8

8:1 Oga awa God, yor greatness full di whole world! Yor glory high pass di heavens. 8:2 Yu don tish shidren and small pikin, so dat dem go fit tok about yor pawa and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu. 8:3 Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place, 8:4 I dey ask mysef, “Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem? Na ordinary human being Yu dey kare about?” 8:5 Yu make dem bi like Yu kon give dem glory and honor. 8:6 Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate, bikos Yu put evritin under dia kontrol; 8:7 all di animals, both wiked and di ones wey nor wiked, 8:8 di birds for di sky, di fish for sea and evritin wey dey swim for wota. 8:9 Oga awa God, yor greatness full di whole world.