Library · pcm

Psalms 95

95:1 Kom make wi sing praiz God! Make wi shaut praiz di Rock wey dey save us. 95:2 As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am. Make wi sing psalms take praiz am. 95:3 Di Oga na great God! Na great King wey pass evry oda god. 95:4 Under di eart dey en hand and na-im get di mountins too. 95:5 Na-im get di sea, bikos na-im make am and na en hand E take make di dry land too. 95:6 Kom! Make wi go woship and bow to am. Make wi knee down before God wey make us, 95:7 bikos na-im bi God. Wi bi en pipol and E dey wosh ova us, bikos na wi E dey kare for. 95:8 God sey, “Make una nor sturbon as Israel pipol do wen dem dey Meribah and Massah wey dey di wildaness. 95:9 Bikos for der, even doh dia grand-grand papa dem si evritin wey I do, dem still test and try my patient. 95:10 So, I vex for dem for forty years kon sey, ‘Dis pipol heart don turn from mi and dem nor gri do wetin I tell dem.’ 95:11 So I kon swear as I dey vex sey: ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey.’ ”