Psalms 94
94:1 My Oga wey dey fight for pipol. Di God wey dey take revensh, make Yu show us yor glory!
94:2 Raiz-up make Yu judge di pipol for di world kon give proud pipol wetin dem deserve.
94:3 My God, na wen Yu won take judge wiked pipol? Na how long wiked pipol go dey celebrate?
94:4 How long dem go dey tok anyhow? Na how long dis wiked pipol go dey make mout?
94:5 Oga God, dem dey kill yor pipol and wound doz wey Yu koll yor own.
94:6 Dem dey kill wimen wey dia husband don die, strenjas and shidren wey nor get papa and mama again.
94:7 Dem sey, “God nor dey si us! Israel God nor even kare about wetin dey happen.”
94:8 But una wey bi fool, make una tink again! Wen una go really get sense to undastand?
94:9 Una tink sey di Pesin wey make una ear nor dey hear word? Abi di Pesin wey make una eye nor dey si?
94:10 If E fit ponish wiked nashons, una tink sey E nor go ponish una? E know evritin, so make una nor tink sey E nor know wetin una dey do.
94:11 God know wetin pipol dey tink; E know sey wetin human being dey tink, dey yuzles!
94:12 So Oga God, make di pipol wey Yu dey ponish, happy. Doz wey Yu dey tish yor ways.
94:13 Yu dey free dem from trobol and dem go dig pit wey go katch dia enemies.
94:14 God nor go rijet en pipol; E nor go leave di pipol wey E love well-well.
94:15 God good judgement go kom again and doz wey get betta and klean heart, go dey save.
94:16 Naw, who go protet mi from wiked pipol? Who go help mi fight doz wey dey do evil?
94:17 If to sey God nor kom help mi, I for don die and pipol for don forget mi.
94:18 But I shaut kon kry sey, “I dey fall” so Oga God wey en love nor dey fail, kom support mi.
94:19 Wen I dey fear sey evritin don finish for mi, Yu kon konfort, give mi new hope and make mi trust Yu.
94:20 Wiked leaders go fit sey God dey dia side? Leaders wey dey use di laws take opress pipol!
94:21 Dem dey plan against di pesin wey dey do wetin dey rite kon kondemn and kill innocent pipol.
94:22 But na God bi di place where I hide put; na my God mi di mighty rock wey dey hide mi.
94:23 So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins. True-true, di Oga awa God go distroy dem.