Library · pcm

Proverbs 1

1:1 Solomon, David pikin wey bi king for Israel, na-im rite all dis wise word. 1:2 E rite dem so dat pipol go get wisdom, undastandin and good advise. 1:3 Dis words go tish una how to live betta life, to dey honest and to dey tok trut and korrect word. 1:4 Dis words fit make pesin wey nor know anytin get sense and e go tish yong men how to work and get money. 1:5 Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin, 1:6 so dat dem go fit undastand proverbs, parabols and wetin wise pipol dey tok. 1:7 For yu to get wisdom, yu most fear God, but na only foolish pipol dey rijet wisdom and good advise. 1:8 My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu, 1:9 bikos wetin dem dey tish yu go bi like betta shain for yor neck and betta kap for yor head. 1:10 My pikin, wen sinnas tempt yu, make yu nor fall for dem. 1:11 If dem tell yu sey, “Kom make wi go kill pesin! Make wi just go attack some innocent pipol!” Make yu nor listin to dem. 1:12 If dem sey, “Even doh di pipol dey alive and okay naw, dem go die wen wi don deal with dem finish! 1:13 Den wi go si plenty good tins karry kom awa house. 1:14 So, kom join us make wi go divide wetin wi tif.” 1:15 My pikin, make yu nor follow dat kind pipol or go near dem at-all. 1:16 Bikos dem dey enjoy to do bad tin and dem always dey ready to kill. 1:17 E nor dey good to set trap wen di bird wey yu won katch dey look yu. 1:18 But pipol wey dey do like dat, dey set trap for demsef and na di trap go kill dem. 1:19 Dis na wetin dey happen to pipol wey play wayo take get propaty. 1:20 Wisdom dey koll pipol for street and inside market, 1:21 e dey shaut dey koll dem from di town gate and anywhere wey pipol gada put. 1:22 Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all? 1:23 How I wish una go gri listin, den I for give una good advise kon share my wisdom with una. 1:24 I dey koll and invite una since, but una nor gri listin or hear mi. 1:25 Una nor gri take my advise or allow mi korrect una. 1:26 So, I go laf una wen una enter trobol kon take una do yeye wen wahala start. 1:27 Dat time, trobol go kom meet una like heavy breeze and una pain go sirious well-well. 1:28 Dat time, una go koll mi wey bi wisdom, but I nor go ansa. Una fit go find mi for evriwhere, but una nor go si mi. 1:29 Una nor ever get wetin to do with wisdom and una nor gri obey God. 1:30 Una nor wont my advise or listin to mi wen I dey korrect una. 1:31 So, una go get wetin fit una and wetin una do, go make una sick. 1:32 Pipol wey nor know anytin, dey die bikos dem rijet wisdom and distroshon go follow doz wey bi fool, bikos dem feel sey wisdom nor koncern dem. 1:33 But anybody wey listin to mi, go dey save and e nor go get rizin to fear.