Library · pcm

Proverbs 2

2:1 My pikin, make yu listin to wetin I dey tish yu and nor ever forget wetin I sey make yu do. 2:2 Listin to wetin dey wise and try make yu undastand am. 2:3 Yes, make yu beg for wisdom and yu go get undastandin. 2:4 Find am well-well, just as yu go take look for silva or oda good tins. 2:5 If yu do like dat, yu go know wetin e mean to fear God and yu go susid as yu dey learn about God. 2:6 Na God dey give wisdom! Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom. 2:7 E dey help and protet raitious and honest pipol. 2:8 E dey protet pipol wey dey trit odas well kon guide doz wey dey respet am. 2:9 So, if yu listin to wetin I dey tok; yu go know wetin dey rite, true and korrect, den kon know wetin yu suppose do. 2:10 Yu go dey wise and di sense wey yu get go give yu happiness. 2:11 Di sense and undastandin wey yu go get, go protet yu. 2:12 Wisdom go save yu from wiked pipol; from doz wey dey lie well-well. 2:13 From pipol wey live good life before dem bigin do bad-bad tins; 2:14 and dem dey happy to do yeye and wiked tins. 2:15 E go still save yu from pipol wey dem nor fit trust; 2:16 from ashawo wimen wey get sweet mout and doz wey won sleep with yu. 2:17 Dis kind woman nor dey faithful to en husband and e don forget di holy promise wey e make. 2:18 If yu go en house, yu just won kill yorsef bi dat. 2:19 Nobody wey go visit am, dey kom back alive. True-true, e nor go ever kom back to life again. 2:20 So, make yu follow wetin good pipol dey do, so dat yu go fit live betta life. 2:21 Raitious pipol and doz wey get respet go stay for di land wey bi awa own. 2:22 But just as dem dey rut plant komot for groun, na so God too go porshu wiked pipol kon rut sinnas komot from di land.