Proverbs 18
18:1 Pipol wey nor kare about odas, dey tink only about demsef; so dem nor go gri take korreshon from oda pipol.
18:2 Foolish pesin nor dey worry weda e undastand sometin or not; di only tin wey dey en mind, na to show how e wise rish.
18:3 Na sin and shame dey waka togeda. Wen yu luz yor honor, pipol nor go respet yu again.
18:4 Word wey pesin tok fit give yu sense wey deep like sea and fresh like river wey dey flow.
18:5 E nor good to favor who do bad, bikos good pipol nor go get korrect judgement.
18:6 Wen foolish pesin start to argue, na trobol e dey put ensef.
18:7 Foolish pesin word dey distroy am; na en own mout dey put am for trobol.
18:8 To do aproko, dey good well-well for mout wen yu dey tok am, bikos e dey sweet for body.
18:9 Lazy pesin bad like pesin wey dey distroy tins.
18:10 God name na strong place to hide put, raitious pipol dey run enter and dem dey-dey save.
18:11 Rish pipol dey tink sey di propaty wey dem get go protet dem like strong high wall wey dey round di town.
18:12 Respet dey kom before honor; but distroshon dey wait for proud pipol.
18:13 Make yu dey listin well before yu ansa, If not, e go bi like sey yu bi stupid pesin wey nor get respet.
18:14 Di mind to live fit enkourage pesin wen e dey sick, but if e nor get strong mind, e nor get hope bi dat.
18:15 Wise pesin dey always look for knowledge and en mind dey find wisdom.
18:16 If yu won go meet important pesin, den karry gift follow body and e go dey eazy for yu to tok to am.
18:17 Di first pesin to tok for kourt dey always dey rite, until di oda pesin ask am kweshon.
18:18 If men wey get pawa dey tok against each oda for kourt, to trow dice fit solve di matter.
18:19 To make peace with yor broda wey yu offend, hard pass to break enter town wey dem guide well-well and kworel, dey separate friends like gate wey dem lock with key.
18:20 Wen yu tok betta words, belle go sweet yu, so make yu let good word kom out from yor mout and yu go dey happy.
18:21 Wetin yu tok fit save or distroy yor life. So yu must asept di result of wetin yu tok.
18:22 Man wey find good woman kon marry am, don si good tin and God go favor and bless am.
18:23 Poor man dey honbol ensef as e dey tok, but rish pipol dey ansa and tok anyhow.
18:24 Friendship if put yu for trobol, but some friends go dey klose to yu pass yor own broda.