Library · pcm

Proverbs 17

17:1 E betta to chop dry bread with peace of mind, dan to get plenty food for house with kworel. 17:2 Savant wey dey bihave well go get pawa for di house pass en oga yuzles pikin and di savant go get share for di oga propaty. 17:3 Na fire dem take dey test gold and silva, but na God dey test pesin heart. 17:4 Wiked pipol dey listin to bad advise and doz wey dey lie, dey listin to lie-lie. 17:5 If yu dey laf poor pipol, den yu dey curse God wey kreate dem, so pesin wey dey happy sey odas fall, God go ponish am. 17:6 Papa and mama dey-dey proud of dia grand-shidren, bikos na shidren bi dia papa and mama crown. 17:7 Since betta words nor fit kom out from fool mout, how e go bi for leaders wey dey lie. 17:8 Some pipol tink sey bribe dey work like majik; dem bilive sey e fit do anytin wey dem wont. 17:9 If yu wont make pipol like yu, den forgive dem if dem do yu bad. Remember sey bad tin fit skata friendship. 17:10 Pesin wey get sense dey take korreshon if dem korrect am wons, but foolish pesin go only take korreshon afta dem don beat am well-well. 17:11 Deat go kom meet wiked pipol wey dey always kause trobol. 17:12 E betta make wiked animal attack pesin, dan to listin to wetin foolish pesin dey tok. 17:13 If yu use bad take pay good, den bad tin nor go ever komot from yor house. 17:14 To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala. 17:15 God nor like pipol wey dey defend wiked pipol and kondemn doz wey dey innocent. 17:16 Foolish pesin nor get time to spend en money to get wisdom, bikos e nor undastand wetin wisdom bi. 17:17 Betta friend dey always show en love and yor relashon go always dey with yu wen yu dey face wahala. 17:18 Na only pesin wey nor get sense go promise to pay anoda pesin debt. 17:19 Pesin wey like to dey kworel, like trobol and If yu always dey karry body up, den yu dey kause wahala for yorsef. 17:20 Make doz wey dey tink and tok bad-bad tins nor espect any good tin escept trobol. 17:21 Papa and mama wey dia shidren dey do like fool, na only sadnes and pain dem dey feel. 17:22 Happiness dey give yu good life, but sadnes dey make pesin die small-small. 17:23 Wiked judge dey take bribe for sekret and bikos of dat, dem nor go give korrect judgement. 17:24 Pesin wey get sense dey tink and do good tins one-by-one, but foolish pipol dey start many tins at wons. 17:25 Foolish shidren dey kause pain for dia papa and dia mama go dey regret. 17:26 E nor good make dem flog innocent pesin and e dey bad to ponish who dey do good. 17:27 Doz wey dey sure of demsef nor dey tok anyhow and kwayet pipol dey undastand tins well. 17:28 Pipol go tink sey foolish pesin get sense wen e kwayet and wen e nor tok, e go bi like pesin wey wise.