Library · pcm

Proverbs 20

20:1 Too mush drink dey make pesin tok and bihave anyhow and pesin wey dey drink too mush, nor get sense. 20:2 Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut; to make am vex, mean sey yu won kill yorsef. 20:3 Na only foolish pesin dey start kworel; so di rite tin to do, na to run from am. 20:4 Farmer wey lazy well-well to klear en farm for di rite time, nor go get anytin to harvest. 20:5 Betta advise for pesin heart bi like wota for inside deep well, but pesin wey get wisdom go draw am kom out. 20:6 Some pipol dey tok how dem dey honbol and faithful, but e go hard to find pesin wey really bi like dat. 20:7 Good pipol dey always do di rite tin and God dey bless dia shidren. 20:8 Wen king sidan for en throne dey judge, e dey fit know bad tin wen e si am. 20:9 E get anybody wey fit sey en mind klean well-well and e nor dey sin? 20:10 God hate pipol wey dey weigh and measure tins with wayo. 20:11 Even shidren dey show who dem bi with wetin dem dey do; den yu go fit know if dem good and dey honest. 20:12 Na God give us eyes to si tins and ear to hear word. 20:13 If na so-so sleep yu dey sleep, na poverty go kill yu. But if yu dey work hard, yu go get plenty food to chop. 20:14 Pesin wey dey buy sometin go sey, “Dis tin too dear! E too dear!” But afta e don buy am, e go-go make mout sey “Dis tin wey I buy so, cheap well-well.” 20:15 To tok with wisdom, betta pass to get gold and silva. 20:16 Anybody wey promise sey e go pay strenja debt, make una hold en propaty until e pay am. Make una hold di propaty if e dey do am for pesin wey kom from anoda kountry. 20:17 Bread wey pesin tif dey sweet for mout, but e go bi like stone for en belle. 20:18 Make yu dey sure sey dem advise yu well, before yu make any plan or go start war. 20:19 Pesin wey dey do aproko nor go fit keep sekret. So make yu run from pesin wey dey tok too mush. 20:20 If yu curse yor papa and mama, yor life go end like lantan wey kwensh for darkness. 20:21 Propaty wey pesin use wayo take kwik get for life, nor dey last. 20:22 Nor do bad to pesin wey do yu bad, but make yu trust God and E go save yu. 20:23 God nor like pipol wey dey weigh and measure tins with wayo. 20:24 Na God dey direct pesin; so how pesin won use en own mind take know as en life go bi? 20:25 E nor good make yu promise God wetin yu know sey yu nor go do. 20:26 Wise king dey skata wiked pipol like flower kon ride horse on-top dem. 20:27 God lite dey enter human being spirit kon open all di plans wey dem get. 20:28 Love wey nor dey fail and goodness dey protet di king and na dis love dey make en throne dey forever. 20:29 Yong pipol glory dey dia strent; so make una respet di white hair wey old pipol get. 20:30 Korrect ponishment dey drive evil komot from pesin mind kon make en heart klean.