Proverbs 21
21:1 Evry king heart dey God hand; just as E dey show river how e go take flow, na so too E dey kontrol kings mind.
21:2 Pesin fit tink sey evritin wey e dey do dey korrect, but remember sey God dey judge evritin wey wi dey do.
21:3 Instead of sakrifice, make pesin do wetin good and korrect; tins wey go make belle sweet God.
21:4 Na pride dey kontrol wiked pipol and anytin wey kom out from dem, na sin e bi.
21:5 If yu plan with kare, yu go prosper; but if yu rush dey plan, na poverty go end am.
21:6 Di money wey yu use wayo take get go disappear, but dat go bi afta e don push yu put for deat hand.
21:7 Na di wahala wey wiked pipol kause dey distroy dem, bikos dem nor gri do wetin dey good.
21:8 Bad belle pipol nor gri do wetin dey rite; but innocent pipol dey do wetin dey good.
21:9 E betta make yu stay on-top house dan to stay with wife wey dey komplain well-well.
21:10 Wiked pipol dey always like to do wiked tins, so dem nor dey pity for anybody.
21:11 Wen God ponish pipol wey dey karry body up, even pesin wey nor dey tink, dey learn lesin. If dem tish wise pesin, e go wise well-well.
21:12 God wey dey raitious know all wetin dey happen inside wiked pipol house and E go distroy dem.
21:13 If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.
21:14 If pesin dey vex for yu; gift wey yu gi-am for sekret go kool en tempa.
21:15 Good pipol dey happy wen dem give korrect judgement, but wiked pipol hope dey die.
21:16 Pesin wey nor gri asept wisdom, go die kon go where dead body dey.
21:17 Pipol wey dey always spend dia money take drink and chop anyhow, nor go ever get plenty money.
21:18 Di wahala wey wiked pipol bin won kause for good pipol, na dem dey use dia own head karry am.
21:19 E betta to stay desert dan to stay house with wife wey dey komplain well-well.
21:20 Wise pesin fit get plenty money and dey enjoy ensef, but as soon as foolish pipol get dia money, dem go spend am anyhow.
21:21 Make yu dey do good and tok trut and yu go get long life; den odas go respet and trit yu well.
21:22 Wise pesin go fit take town wey strong men dey guide kon distroy di wall wey bi dia hope.
21:23 If yu nor won enter trobol, make yu tink before yu tok.
21:24 Pesin wey dey karry body up and do wayo, nor dey kare about oda pipol.
21:25 Lazy pipol wey nor gri work dey kill demsef and
21:26 na wetin dem go like get, dem dey always tink about, but good pipol sabi give well-well, bikos dem nor stingy.
21:27 God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.
21:28 Pipol nor dey bilive anytin wey lie-lie pesin tok, but pesin wey dey tink before e tok, dem dey bilive en word.
21:29 Good pipol dey-dey sure of demsef; but wiked pipol sabi pritend well-well.
21:30 Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.
21:31 Pesin fit ready en horse sey e dey go fight war, but na only God go gi-am viktory.