Library · pcm

Proverbs 22

22:1 If yu nid to choose between good name and plenty propaty, make yu choose good name, bikos respet betta pass silva and gold. 22:2 Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem. 22:3 Wise pipol dey si trobol dey run, but foolish pipol go run enter kon sofa pain. 22:4 If yu obey God kon honbol yorsef, yu go get propaty, honor and long life. 22:5 Trobol and wahala dey where wiked pipol dey waka pass, but wise pipol wey sabi guide dia soul, dey-dey far from dem. 22:6 Make yu tish yor pikin how e go take live en life and wen e don old, e go still dey do di same tin. 22:7 Na rish pipol dey rule poor pipol and if yu borrow money from pesin, yu go bi en savant. 22:8 Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end. 22:9 Do good and share yor food with poor pipol, den God go bless yu. 22:10 If una porshu proud pipol komot from where una dey, kworel, wahala and bad words, nor go dey again. 22:11 Pesin wey get klean heart and always dey tok well, di king go always bi en friend. 22:12 God dey protet doz wey dey tok trut, but doz wey dey lie waka, E dey distroy dia plans. 22:13 Lazy pipol dey always sey, “Lion dey outside and e go kill us”, so dem nor go gri go out. 22:14 Pesin wife wey dey sleep with oda men, dey get sweet mout and doz wey God dey vex for, dey fall enter di woman trap 22:15 Shidren nor dey know sey di way dem dey bihave nor good, but betta korreshon go tish dem how to bihave well. 22:16 If yu dey give rish pipol gift kon dey opress poor pipol make yu for get more money, yu go poor too. 22:17 Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok and as yu undastand wetin dem tok, 22:18 yu go happy, if yu remember and use dem well. 22:19 I go tell yu evritin naw, bikos I wont make yu trust God. 22:20 I don rite thirty words wey go give yu wisdom, betta advise and 22:21 tish yu wetin trut really mean. So if dem send yu go find am, yu go bring korrect ansa kom back. 22:22 Make yu nor trit poor pipol anyhow bikos yu get pawa! Doz wey nor get help for kourt, make yu nor trit dem anyhow too, 22:23 bikos God go judge dia kase for dem kon ponish doz wey dey treaten dia life. 22:24 Make yu nor make friend with pipol wey get hot and bad tempa, 22:25 bikos if yu learn dia behaviour, yu nor go fit shange again. 22:26 Make yu nor promise to pay money wey anoda pesin dey owe, 22:27 bikos if yu nor fit pay, dem go kon karry yor bed go. 22:28 Make yu nor remove di old boundary stone wey yor grand-grand papa dem take mark where dia land for end. 22:29 Yu don si pesin wey get good work? E dey-dey with kings and nor bi with yeye pipol.