Library · pcm

Proverbs 28

28:1 Wiked pesin dey run wen nobody dey porshu am, but honest pesin dey get heart like lion. 28:2 Wen pipol dey always sin, dia kountry go get many leaders, but pesin wey get sense and dey undastand tins well, dey bring peace. 28:3 Poor man wey dey opress oda poor pipol, bi like strong rain wey dey skata wetin pesin plant. 28:4 So pesin wey nor dey respet di law, dey praiz wiked pipol, but doz wey dey obey di law, nor like wikedness. 28:5 Evil pipol nor know wetin korrect judgement mean, but doz wey dey woship God, undastand am well-well. 28:6 E betta to dey poor and honest, dan to dey rish and dey do wayo. 28:7 Yong man wey dey obey di law get sense. Pesin wey dey make friends with yeye pipol na disgrace to en papa. 28:8 If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol. 28:9 If yu nor dey obey di law, God nor go hear yor prayers. 28:10 If yu deceive honest pesin kon make am do bad tins, yu go fall enter di trap wey yu dig by yorsef, but God go reward innocent pipol well-well. 28:11 Rish pipol dey always tink sey dem wise, but poor pesin wey get betta karata, know di rite tin. 28:12 Wen good pipol dey rule, evribody dey happy, but wen bad pipol dey rule, evribody dey hide. 28:13 Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin. Konfess and stop to do dem and God go show yu mesi. 28:14 If yu always dey obey God, happiness go follow yu, but yu go distroy yor life if yu dey sturbon. 28:15 Just as pipol dey fear hongry lion and wiked bear, na so too poor pipol nor fit fight wiked ruler. 28:16 Ruler wey nor get betta sense, go rule with wikedness. But pesin wey nor like lie, go rule tey. 28:17 Pesin wey kill anoda pesin dey kwik-kwik dig en own grave, so make yu nor try to stop am. 28:18 Dey always tok trut and e go save yu, but if yu dey play wayo, na wons yu go fall. 28:19 Farmer wey dey work hard, get plenty food to chop, but pipol wey dey waste time for evritin wey dem dey do, na poverty go kill dem. 28:20 Pesin wey dey tok trut, go live betta and happy life, but dem go ponish yu, if yu dey hurry to get money. 28:21 To dey judge anyhow nor good, but some judge dey lie for kourt, bikos of di small bribe wey dem won kollect. 28:22 Pesin wey get long-trot dey always hurry to get money, sotey e nor dey know wen poverty dey kom meet am. 28:23 If yu korrect pesin, e go like am pass wen yu praiz am. 28:24 Pesin wey tink sey e nor bad to tif from en papa and mama, nor betta pass ordinary tif. 28:25 To get long-trot dey only kause trobol, so e betta make yu trust God. 28:26 Pesin wey feel sey na only en know di korrect tin, na big fool, but pesin wey dey waka with wisdom, go dey save. 28:27 Make yu dey always give tins to poor pipol and yu nor go ever lack, but if yu nor dey sorry for poor pipol, dem go curse yu. 28:28 Pipol dey hide wen wiked pesin dey rule, but wen e nor dey again, raitious pipol go prosper.