Library · pcm

Proverbs 29

29:1 If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again. 29:2 Make yu show mi good ruler and I go show yu happy pipol. Make yu show mi wiked ruler and I go show yu pipol wey dey komplain. 29:3 If yu value wisdom, yor papa go dey proud of yu, but na foolish tin to spend money for ashawo. 29:4 With betta judgement, king dey make en kingdom strong, but king wey like money well-well, dey skata en throne. 29:5 Pesin wey dey praiz en neighbour anyhow, dey set trap for dem. 29:6 Di sin wey evil pipol kommit dey put dem for trobol, but honest pipol, dey-dey happy and free. 29:7 Good pesin know wetin bi poor pipol own, but wiked pipol nor fit undastand tins like dat. 29:8 Pipol wey nor get respet for odas, go fit kause konfushon for di whole town, but wise pipol dey keep tins to demsef. 29:9 Wen wise pesin take foolish pesin go kourt, di foolish pesin go only dey shaut and tok anyhow, but e nor go dey happy. 29:10 Pipol wey dey kill pipol nor like anybody wey dey tok trut, but good pipol go protet di pesin life. 29:11 Stupid pipol dey show dia vexnashon for publik, but pipol wey get sense, dey-dey patient and kontrol demsef. 29:12 If ruler dey listin to lie-lie word, den all en ofisas go dey plan wiked tins. 29:13 Just as God give eye to poor pesin, na so too E give eye to pesin wey dey opress oda pipol. 29:14 If king dey defend poor pipol, e go rule tey well-well. 29:15 To dey beat and korrect shidren, good well-well, bikos if dem dey do anytin wey dem like, dem go make shame katch dia mama. 29:16 Wen wiked pipol dey rule, many bad-bad tins dey inkrease, but good pipol go dey alive to si di way doz wiked pipol go take fall. 29:17 Korrect yor shidren and yu go dey proud of dem, bikos dem nor go make yu shame at-all. 29:18 Wen pipol nor follow God way, dem dey waka anyhow, but pipol wey dey obey God law, na happiness bi dia own! 29:19 Pesin nor fit korrect en savant with just ordinary word, bikos even doh dem undastand am, dem nor go do wetin e tok. 29:20 Yu don si pesin wey dey tok anyhow? Even fools get hope pass am. 29:21 If yu give yor savant evritin wey dem wont from small kom, one day, dem go take evritin wey yu get. 29:22 Pesin wey get hot tempa dey kause kworel and pesin wey dey kwik vex, dey sin well-well. 29:23 Pesin pride go distroy am, but if e dey honbol, pipol go respet am. 29:24 Pesin wey bi tif patina nor like en life, bikos even doh e know di trut, e don swear sey e nor go tok. 29:25 E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save. 29:26 Evribody wont make king favor dem, but na only God dey give korrect judgement. 29:27 Good pipol nor like doz wey dey do wiked tins and wiked pipol nor like good pipol.