Proverbs 5
5:1 My pikin, make yu listin to my wisdom and put yor ear down for di words wey I dey tish yu.
5:2 Den yu go know how to bihave well and di way yu go dey tok, go show sey yu get wisdom.
5:3 Anoda man wife lip fit sweet like honey and en kiss dey smooth like oil,
5:4 but wen evritin don finish, yu nor go gain anytin inside escept pain and bitterness.
5:5 Di woman go take yu go where dead body dey, bikos dat road dey lead to deat.
5:6 Di woman nor dey tink about di road wey dey save; e dey waka lost but e nor know.
5:7 But my pikin, make yu listin to mi and nor forget wetin I dey tok.
5:8 Run from dat kind woman; nor even go near en door.
5:9 If yu follow am, nobody go respet yu again and strenjas go take evritin wey yu get.
5:10 Yes! Strenjas go take all yor propaty and anoda pesin go kollect evritin wey yu work for.
5:11 Den for di end, yu go kry with pains kon die go like dat.
5:12 Den yu go sey, “Why I nor follow wetin dem tish mi? Why I nor let dem korrect mi?
5:13 Why I nor obey my tishas! Why I nor do wetin dem tok?
5:14 Naw, na wons dem disgrace mi for publik.”
5:15 Just as yu go take wota from yor own well, na so too make yu dey faithful and love only yor wife.
5:16 Make yu nor just bi like river wey anybody fit drink from.
5:17 Make yu keep yorsef for yor wife alone and know bi for strenjas.
5:18 So always dey happy with yor wife and find joy for di woman wey yu marry from di biginnin,
5:19 bikos e fine and dey honbol like deer. Make en smile dey make yu happy and make en love satisfy yu.
5:20 My pikin, why yu go-go give yor love to anoda woman? Wetin make yu like di way anoda man wife bi?
5:21 God dey si evritin wey yu dey do and E know evriwhere wey yu dey go.
5:22 Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.
5:23 E go die bikos e nor fit kontrol ensef. Na en yeye life go send am go en grave.