Proverbs 4
4:1 My pikin, make yu listin to wetin yor papa dey tish yu; put yor ear down and yu go undastand.
4:2 Remember evritin wey I dey tish yu, bikos dem dey good.
4:3 Wen I still bi small boy for my papa house and as my mama only pikin,
4:4 my papa go tell mi, “Make yu always remember wetin I tish yu. Do wetin I tok and yu go get long life.
4:5 Ask for wisdom and undastandin! Nor forget or abandon wetin I tok.
4:6 If yu love wisdom, e go protet yu; if yu love am well-well, e go save yu.
4:7 Na wisdom bi di best tin to get. If yu go get any oda tin, make e bi undastandin.
4:8 Love wisdom and e go make yu great; draw am near body and e go bring respet for yu.
4:9 Wisdom go give yu grace, e go bi like fine crown for yor head.”
4:10 So my pikin! Make yu listin to mi; make yu take evritin wey I dey tell yu sirious, den yu go get long life.
4:11 I don tish yu wisdom and di korrect way to live yor life.
4:12 Nor-tin go stand for yor way if yu dey live wise life, den yu nor go fall wen yu dey run.
4:13 Make yu always remember evritin wey yu don learn, bikos na wetin yu learn go give yu good life, so make yu guide am well-well.
4:14 Nor go where wiked men gada put or follow wetin dem dey do.
4:15 Nor do or go near bad tin! Make yu rijet am kon go yor way.
4:16 Wiked pipol nor dey fit sleep until dem do bad tin. Dem nor go gri rest until dem wound pesin.
4:17 Wikedness and wahala bi like food and drink to dem.
4:18 Raitious pipol ways bi like sun for morning wey dey shine well-well go rish evening.
4:19 But wiked pipol road dark well-well; dem go fall and dem nor go si wetin make dem fall.
4:20 So, my pikin, make yu hear wetin I dey tok kon listin to my words.
4:21 Nor ever let dis words leave yu, remember and protet dem with yor heart.
4:22 Bikos dem dey give life and betta body to anybody wey undastand dem.
4:23 Make yu dey kareful about wetin yu dey tink, bikos na wetin yu tink for yor heart, yu go do.
4:24 Nor ever lie. Nor do anytin with pipol wey dey lie or tok bad words.
4:25 Make yu look strait and nor bow yor head, bikos yu dey shame.
4:26 Anytin wey yu won do, make yu plan am well, den evritin wey yu do go dey okay.
4:27 Make yu run from bad tins kon waka for strait road, so dat yu nor go turn go left or rite.