Library · pcm

Proverbs 7

7:1 My pikin, make yu remember wetin I dey tok; nor forget wetin I sey make yu do. 7:2 Do wetin I tok and yu go get good life! Protet all wetin I tish yu just as yu go protet yor eye. 7:3 All wetin I tish yu, make dem always dey with yu and make yu rite dem for yor heart. 7:4 Trit wisdom like yor sista and undastandin like yor best friend. 7:5 Dem nor go make yu put eye for anoda man wife body and wimen wey get sweet mout. 7:6 One day, I dey look outside from my window 7:7 and I si many men wey nor get sense, but I notis one among dem wey foolish well-well. 7:8 E dey waka pass one road near di korna wey one woman dey stay. E waka near en house 7:9 for evening wen day don dark well-well. 7:10 Den di woman go meet am; e dress like ashawo and e get bad plan for mind. 7:11 Di woman dey tok anyhow and e nor dey shame, bikos e dey always waka for di street 7:12 or stand dey wait for korna and sometaims, e go dey di market side. 7:13 E trow en hand round di yong man neck, kiss am, look strait enter en eye kon sey, 7:14 “I get fresh meat for house and today, I don do wetin I promise. 7:15 Na dis make mi kom out kon look for yu and I don si yu! 7:16 I don dress my bed with fine kolour linen wey I bring from Egypt. 7:17 I don put myrrh, aloe and cinnamon perfume for di bed. 7:18 So, make yu kom! Make wi go sleep togeda till day break and wi go enjoy awasef. 7:19 Bikos my husband nor dey house; e don travel go far-far place. 7:20 E karry plenty money follow body and e nor go kom back until mont end.” 7:21 So e tempt di man with en beauti and di man fall for en sweet tok. 7:22 Small time, e bigin follow am like melu wey dem won go kill and like animal wey waka fast enter trap 7:23 where arrow go for enter en heart. E bi like bird wey dey enter net and e nor know sey en life dey danger. 7:24 So naw, my pikin, make yu listin and hear wetin I dey tok. 7:25 Nor let dat kind woman win yor heart; nor run follow am at-all. 7:26 Bikos e don skata many life and distroy and kill many men. 7:27 If yu enter en house, den deat dey hongry yu, bikos na short kut to deat bi dat.